Wia dis foto come from, Presidency/Simon Ekpa/X
Nigeria President Bola Tinubu hail Finland goment for di arrest and detention of Simon Ekpa and warn say im goment ''no go tolerate actions and statement wey go cause division among kontri pipo''.
President Tinubu tok dis wen e host Finland ambassador Sanna Selin for Abuja on Friday.
Dis na di first time wey di Nigerian leader dey address Ekpa case since im chop arrest last year on charges of alleged terrorist activities for Finland.
''I be pikin wey dey born into activism, but no be to scata. We need cooperation to bring development. Our watchword na stability and cohesion to move di kontri forward''. President Tinubu tok.
"Di National Security Adviser, Malam Nuhu Ribadu, don informe me. I know wetin di rule of law mean. Di rule of law safeguard our democratic credentials, morals and values. We must respect di rule of law,'' President Tinubu add put.
End of Recommended articles
Meanwhile di Finnish ambassador drop update on Ekpa case.
"Simon Ekpa dey hinder bilateral relations. Di cooperation between our two kontris dey go very well now, and di National Security Adviser dey provide all di evidence,''. Di ambassador tok.
Ekpa, na Finnish citizen wey come from Nigeria, accordng to am, im say im dey lead one faction in exile of di Indigenous People of Biafra (Ipob) – dem be group wey dey fight for a breakaway state for south-eastern Nigeria.
Although Ekpa don previously deny any links to di current kill- kill and violence for Nigeria south-east region, wia dem bin fight civil war for di late 1960s.
Im link himself to Ipob and describe himself as di "prime minister of Biafra Republic Government-in-Exile".
But, Ipob, wey dey banned for Nigeria, don wash dia hand comot from Ekpa.
For March 2024, Nigerian army declare Ekpa and 96 oda wanted for terrorism, violent extremism and secessionist threats.
And den for November 2024, Finnish detectives say Ekpa incite "violence against civilians and public authorities and oda crimes for south-east Nigeria" while in dey Finland.
"Im carry out dis activity by campaigning, for example, for social media channels," Otto Hiltunen, di head of Finnish National Bureau of Investigation, tok.
Ekpa dey live for Lahti city, north of di Finnish capital, Helsinki, wia im dey serve as a local representative for Finland conservative National Coalition Party, according to tori pipo AFP news agency.
Wia dis foto come from, Simon Ekpa/X
Dis na di second time wey authorities for Finland dey arrest Simon Ekpa. Dis one na new arrest and e neva clear how dis mata go be.
Finland authorities bin don first arrest Ekpa once bifor as suspect of one crime.
For 2023, di National Bureau of Investigation arrest am on suspicion of money collection offence.
Dat time, di police arrest am, but later release am dat same evening.
Simon Ekpa na Nigerian-Finnish Biafran agitator wey be self-acclaimed disciple of detained leader of di Indigenous People of Biafra, Nnamdi Kanu.
Ekpa wey dey live for Finland dey champion di restoration of Biafra Republic and calling on Igbo pipo wey dey for southeast to boycott di general elections unless di Federal Goment release Kanu.
Ekpa for im Twitter page describe imsef as human rights activist, CEO, senior legal advisor at Ekpa & Co Oy, legal researcher, author, analyst, Finnish politician and Biafra tok-tok pesin.
E currently get ova 60,000 followers on Twitter and na one of di social media wey im dey use give pronouncements to im followers.
© 2025 BBC. De external site no concern BBC. De way wey we de take go external link.
