National grid collapse: ‘Recovery work don almost complete’ TCN tok – BBC.com

Wia dis foto come from, Getty Images
Di transmission company of Nigeria say di recovery work for di national grid wey collapse on Monday don almost complete.
Di collapse of di grid affect electricity supply for di kontri as most homes no get power supply since den.
For statement wey di tok-tok pesin Ndidi Mbah release on Tuesday, e say ''Work to fully recover di grid still dey go on’’.
‘’Di grid recovery process don reach advance stage, and dis don ensure bulk power availability to about 90% of our substations nationwide. Mbah add put
TCN say dem don restore power supply to Abuja axis and oda major distribution load centres nationwide.
Di grid collapse no affect Ibom gas generating station wey dey supply places like Eket, Ekim, Uyo and Itu, TCN tok.
E no dey clear wetin cause di grid to collapse but TCN say as soon as dem fix am, dem go investigate di mata.
TCN tok dey come as some Electricity Distribution Companies for di kontri bin react to di darkness wey Nigerians dey facei.
"Kindly dey informed say system collapse bin happun at about 18:48 hours (7.48pm) on Monday 14th October, 2024 wey reult to di loss of power across our network.
Restoration of power dey go on with our relevant customers. Make una bear with us." di statement read.
Dis na di sixth time in 2024 alone wey di national electricity grid go collapse.
Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Twitter post, 1
Content is not available
Even as some parts of Nigeria dey experience total blackout, Abuja di Nigeria capital get light.
According to di Abuja Electricity Distribution Company (AEDC) di national grid collapse around 6.58 pm on Monday evening but light don come back.
However, dem notify residents of Abuja wey dey stay for areas like Arab road, Gwarimpa and oda places wey near di area say dem go do maintenance between 10 O' Clock in di morning and 6 O' Clock for evening on Wednesday 16 October , 2024.
Dem go do di maintenance ontop di 33KV Dam feeder and 33KV Dei-Dei feeder.
Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Twitter post, 2
Content is not available
Di collapse of di national grid dey make Nigerians vex well-well sake of say no be di first time di grid dey collapse.
Only for 2024 di national grid don collapse more dan four times and e dey affect di lives and businesses of Nigerians.
Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Twitter post, 3

End of Twitter post, 4

End of Twitter post, 5
Content is not available
Power outage no be new tin for Nigeria as many pipo no dey used to uninterrupted power supply for dia area.
But wen light no dey for large parts of di kontri, pipo dey usually ask questions.
Dis questions most time na wetin be national grid and why e dey always collapse.
E no dey clear wetin dey always collapse di national grid wey dey mostly supply light to di kontri.
But di Minister of Power wey President Bola Tinubu appoint Adebayo Adelabu, bin promise to reform and transform di power sector of di economy.
Even though light don improve for some areas, many Nigerians dey enta into unprepared darkness sake of dis unplanned national grid collapse evritime.
Nigeria national grid na di public electric power wey dey supply light to homes, offices and oda places all ova di west African nation.
Na just over 4000MW megawatts of electricity Nigeria get for di grid to supply over 200 million Nigerians.
And sake of dis, steady public power supply all over Nigeria na still headache even for di kontri economy.
Di work of generating companies (GenCos), na to produce electricity for Nigeria.
Di kontri get six companies wey dey generate electricity plus 28 power plants.
Three out of di 28 power plants dey use water take create light while di remaining 25 dey depend on gas.
All of di six GenCos na private companies and dem each get 60% shares while federal goment keep 40%.
Afta GenCos don produce di electricity, na di responsibility of di transmission company to transport am from wia dem produce am to wia dem go distribute am.
Transmission Company of Nigeria na only one and na di only company wey get di right to transport electricity for di kontri. E belong to di federal goment.
© 2024 BBC. De external site no concern BBC. De way wey we de take go external link.

source

Leave a Comment

WP2Social Auto Publish Powered By : XYZScripts.com